MBN

ARTİCLE

South Africa vs DR Congo: Williams penalty saves help South Africa defeat DR...

Longlegs: Why grisly serial-killer horror Longlegs is this summer's gre...
Published Time: 11.02.2024 - 02:19:17 Modified Time: 11.02.2024 - 02:19:17

DR Congo create di most chances first from Silas, den Wissa and Mayele but all three of dem fail to hit di target. South Africa vs DR Congo


to take....

South Africa 6-5 DR Congo

South Africa 5-5 DR Congo.

, advantage South Africa. South Africa 5-4 DR Congo.

kick dey South Africa 4-4 DR Congo. Dis shootout don enter sudden death.

Now if DR Congo score dis shootout don end.

South Africa 4-4 DR Congo.

as im shoot straight again beyond Williams. South Africa 3-4 DR Congo.

left foot di goalkeeper follow am but e no fit stop am. South Africa 3-3 DR Congo

wey im shoot straight. South Africa 2-3 DR Congo

manage to shoot di ball South Africa 2-2 DR Congo.

don step up, imSouth Africa 1-2 DR Congo.

shoot to di right and South Africa 1-1 DR Congo.

high into di net. South Africa 0-1 DR Congo.

di first kick for South Africa. Im shot hit di goalkeeper right-hand post.

90+3 mins - Wissa wit anoda opportunity to score...o no im jab di ball from a cross go over. Penalties na im go settle dis game.

90 mins - Into five minutes of stappage time.

89 mins - Mayembela time for dis game don end, Lepasa don enter.

Meanwhile Mayele pounce pm Xulu mistimed header, e control well but e finish narrowly miss di goal.

85 mins - Bertaud wit a good save to deny Mayembele wey almost open di scoring. Mayembele play one-two wit Mudau, di return pass see di winger free inside di area. Im take one touch before e shoot di ball straight into Bertaud.

81 mins - DRC wit a quick counterattack to catch di South Africa out by surprise. Wissa find Elia wit a pass but di winger effort to dribble im marker see am go jam im own player.

78 mins - Banza and Silas time for dis match don end. Cedric Bakambu and Fiston Mayele don enta di match.

75 mins - Chancel Mbemba wit good chance to score, di defender wey find imsef free inside di box shoot over from four yards. Wow! Nobody wan score for dis game. If e end like dis we go enter extra-time.

72 mins - South Africa make anoda substitution. Morena wey look tired don exit di game and na Mashego take im place.

68 mins - Mayembela left foot shot dey saved by Bertaud.

67 mins - Substitution for DRC; Wissa don take di place of Diangana.

65 mins - How DRC no score for dia? Williams fail to catch one up ball, e fall for Elia wey try to cross di ball for Banza to head in but e no reach di striker instead e reach Silas wey fail to keep im shot on target.

59 mins - Substitution for South Africa: Thabang Monare and Oswin Appolis don come on, Zwane and Makgopa don go off.

Just before di substitution Elia way one better shot from a freekick straight at Williams. Di keeper first drop di shot before e later catch di ball.

54 mins - DRC dey knock on Bafana Bafana door here, dis time Silas connect well wit a cross from di left but im cutback wey look like shot end inside di arms of Williams.

52 mins - DRC come close again from Diangana. Banza knock di ball down for Diangana wey shoot am first time well ova di bar.

50 mins - Banza go close to scoring for DRC wit a volley from just inside di area. Di shot whistle past Williams left-hand post.

46 mins - Di second half don resume.

Ahead of di start of di second half, DRC make substitution. Omenuke Mfulu to take di place of Tshibola wey bin dey on yellow card.

45 mins - Moutoussamy try to bend one in with im left foot from outside box, di shot rise high over di bar. We don enter into two minutes of added time.

43 mins - Mayembela produce South Africa first real chance of dis game wit a right foot curler from outside di box. Bertaud save am well.

39 mins - DRC now wit a quick break by Silas, im try to dribble im marker but Mudau stand firm to clear. Di ball fall for Diangana wey cross am into di box for Banza, di cross dey too strong e go out for goalkick.

37 mins - Moutoussamy slip den come foul Mudau. Dis na good opportunity for South Africa to threaten DRC goal. Modiba send di cross in, Batubinsika head am clear.

33 mins - Bongonda no fit kontinu, Meschack Elia don replace am.

30 mins - Theo Bongonda look like im don pick up injury. Di 28-year-old need treatment as di players don go for cooling break.

28 mins - Yellow card for Tshibola, di midfielder pull back Mudau from advancing forward.

26 mins - Simon Banza and DRC beat South Africa offside trap again wit a through ball from over di top. Di striker control well but im shot dey to weak to trouble Williams.

19 mins - Evidence Makgopa try im luck wit a volley from outside di area, im shot fly high and wide.

15 mins - No real goalmouth action so far except for some midfield challenges. Wetin dey noteworthy sha na di sound of di beating drums from supporters of DRC.

9 mins - Silas Katompa wit a good chance to open di scoring. Di forward beat Bafana Bafana offside trap and find himself wit just di keeper to beat. Silas try to dribble Williams but di goalkeeper catch di ball at im feet.

7 mins - South Africa hold dia defence line well to clear a cross from Bayeye inside di area from causing any problems.

3 mins - DRC make nine changes to dia starting lineup as coach Dessabre use dis game as opportunity to field players wey never really see game time for dis Afcon.

: Williams; Mudau, Xulu, Sibisi, Modiba; Sihole, Mokena, Zwane; Mayambela, Makgopa, Morena

: Yaka; Kifutu, Buduka, Tshibola, Diangana, Moutoussamy, Bongonda, Kotompa, Ditu, Mbemba, Bokote

ARTİCLE