MBN

ARTİCLE

Kimberly Cheatle: U.S secret service director Kimberly Cheatle resign afta a...

Beirut: Israel claims it killed Hezbollah commander in Beirut strike ...
Published Time: 23.07.2024 - 18:19:57 Modified Time: 23.07.2024 - 18:19:57

Cheatle tok say she no want calls for her resignation to be "distraction from di great work each and evri one of dem don do towards dia vital mission". Kimberly Cheatle


Cheatle tok say she no want calls for her resignation to be "distraction from di great work each and evri one of dem don do towards dia vital mission".

She go on to say she go always put di need of di service first, and na "difficult" decision "wit heavy heart" to step down.

End of Recommended articles

Cheatle thank her colleagues and she tok say dem deserve di nation support in "carrying out di critical mission.

House Speaker Mike Johnson tok say her resignation "don dey overdue” as di head of di Secret Service director.

E tok say "she suppose don do dis one week ago".

Johnson add say e dey "glad she don listen to di call" - from both Republicans and Democrats.

"Now we go pick up di pieces", e tok.

In di meantime, US President Biden tok say e go appoint new director for di Secret Service soon.

Inside one statement, di president say im and im wife Jill dey grateful to Cheatle for her decades of public service.

"She don selflessly dedicate and risk her life to protect our nation throughout her career in di United States Secret Service," Biden tok.

E add say "e take honour, courage and incredible integrity to take full responsibility for di organization, wey dey task wit one of di most challenging jobs for public service".

Biden tok say e dey look forward to independent review into wetin happun on 13 July, wen gunman don clear line of view to Donald Trump during rally for Pennsylvania and try to assassinate am.

Monday hearing bin dey bad for Ms Cheatle, as lawmakers mock her answers and di lack of information di agency bin make public.

For nearly six hours, di lawmakers bin try to find answer to questions di shooting, wey include how di suspect Thomas Matthew Crooks, fit climb nearby rooftop and why dem allow Trump climb di stage even afta report of suspicious pesin.

Afta di hearing, di leading Republican and Democrat from di committee - James Comer and Jamie Raskin – bin send one letter to Ms Cheatle wey lay out dia belief say make she vacate her office.

"For di middle of a presidential election, di Committee and di American pipo dey demand serious institutional accountability and transparency wey you no dey provide," di letter tok.

"We call on you to resign as director as first step to allow new leadership to quickly address dis crisis and rebuild di trust of a truly concerned Congress plus di American pipo."

While Ms Cheatle take responsibility during di hearing for di security lapses and agree say di Butler incident mark "di most significant operational failure of di Secret Service in decades", she bin leave many lawmakers frustrated.

Ms Cheatle don ignore di calls for her to resign, she say she be di "best pesin to lead di Secret Service at dis time".

Di Secret Service director also answer few questions directly – she say di investigation dey on.

"American pipo get questions, [and] dem deserve answers," Oversight Committee Chairman Mr Comer tell Ms Cheatle.

"You suppose provide answers and, ma'am, you no do am."

At times, di hot hearing go be like say e don turn to battle field as di lawmakers seriously dey para as dem dey tok.

Lawmakers use curse words, shout for di witness and question di director honesty and competence.

"Your performance tire me," Florida congresswoman Anna Paulina Luna tok.

E be like say Ms Cheatle answers dey always vex di lawmakers wey dey di committee, many of dem tok say make dem free her if she continue to refuse to resign.

Throughout di hearing, some representatives roll dia eyes, or mumble loudly in response to Ms Cheatle comments.

For one of di hottest moments of di hearing, South Carolina Republican Nancy Mace tok say Ms Cheatle no dey honest wit her answers.

"You dey dishonest or dey lie," Ms Mace tok. "You just dey dodge di questions!" She later file congressional motion to impeach Ms Cheatle, to force her out of di job.

Anoda Republican, Georgia Marjorie Taylor Greene, bin shout for Ms Cheatle head, and refer to her as "total failure".

Oda members, like Colorado Lauren Boebert and Ms Luna of Florida, bin hint say conspiracy theories don surface online.

Florida Republican Michael Waltz blame Ms Cheatle for di rumours, as e argue say misinformation "dey fly" for di absence of information.

"I for don fire you just by how you handle dis mata," Oga Waltz tok, "because na you suppose first face di mics."

Several eyewitnesses to di shooting for Butler bin tell BBC say Ms Cheatle answers bin leave dem feeling frustrated and angry.

"She dey try to pass di responsibility," Jean Vincent, one Butler resident tok. "I surprise at how her answers no reach. She need to dey held accountable for her total lack of competency... she put our lives at risk and need to take responsibility."

Kimberly Cheatle na di 27th Director of di U.S. Secret Service.

Dem swear am in to office 17 September 2022.

She dey responsible for successfully executing di agency integrated mission of protection and investigations by leading a diverse workforce wey get more dan 7,800 Special Agents, Uniformed Division Officers, Technical Law Enforcement Officers, and Administrative, Professional, and Technical personnel.

Before her appointment, Ms. Cheatle serve as Senior Director for Global Security for PepsiCo, where she bin dey responsible for directing and implementing security protocols for di company facilities for North America.

Her role for PepsiCo na to develop risk management assessment and risk mitigation strategies.

Before she join PepsiCo, she bin work wit distinction for 27 years for di U.S. Secret Service, most recently as Assistant Director of di Office of Protective Operations.

ARTİCLE